Omo this story long ooo buh if colos never kill one person wey you know or kill you, you no go get sense ..
Make una tag that colos presido under this tweet abeg 😂..
Today go make am three years now way I lose one of my nigga to Colorado(Rip my bro) ,back in 2022. All of us gather day lodge day smoke up (we we’re three) ,loud day ,Colos day ,542 day ,Elle day ground ,men wan just day on another planet . That particular market(colos) na new market ,na “cripple”be the name and my dealer sef let me know say no be chice because as of that time guyy I day smoke watin no good for Colos,e day hard to see the one way fit carry me trabaye and that cripple no disappoint. So we day setting day smoke up o ,each of us hold our 2rubbers of Elle ,half card of 542 each and their sticks of loud,then I con roll one jumbo size c.o . Me gan as I light up the Colos,the smell wicked ,first passing, all man go 1 puffs first so we go sabi the frequency and guyy we confirm am😭,but no shaking ! we still mount ,we day on two more then we pause ,everyman day do their thing. Na so them call me for compound say them day pump water for hostel and my tap day open,water don almost full my room . Omo i let my guys know say I gats reach house and I day come back ,and I specially warn them about that C.o because e go far gan ,and their head no too strong like that . Bro as I reach house ,I no know as I take reach bed after turning off my tap . As I day wake up for morning ,I day see text and calls from one of my guys there say the other chop 4 puffs straight because say them bet!??? 80k!!! and now he no day breathe again say e day panic . On G immediately I packed up some little clothes and left for Lagos asap ,thankfully the hotel cctv no day work ,so my face no show. My other guy had to sell his car ,with support from me and his family members before we died down that case and compensated my late guy’s family . Since then till date I neva see watin go make me smoke c.o again🤕.