If you are 22 - 30 , pls come closer .
Just imagine o.
Papa no get, Mama no get, Aunty no get, Brother no get —
na only you dey hustle , trying to scale up .
In this life,
wetin dey pursue you go determine how fast you go move.
Person wey snake dey chase no fit run the same pace as person wey rat dey chase.
Levels dey.
Chioma get 7 wigs — congratulations to her.
You, rock your 3 or 5 and look clean. Nobody send anybody.
Seun get 1m dey sleep for account — devaluation and inflation go finish am.
You, push your own into ETFs, stocks, assets wey fit protect your purchasing power.
Who get money pass no concern you.
Who dey show off no concern you.
Your goals, your ambition, your destination — odikwa totally different.
Like , Are you getting me ?