Owning a car covers up a lot for you as a man thatβs why owning a car has moved from being a luxury to being a necessity.
Car dey cover shame a lot.
You fit no get money again but if you still get car, Nobody go know say you don broke.
The day people go know say you don broke na the day wey you use that car get small accident and you no fit fix am immediately, You come go dump am for mechanic workshop.
Na there you go cast because almost everybody wey sabi say you get ride go ask you every single day
βWhere your car nau?β
βYou no drive comot today?β
βThis one wey you dey enter bikeβ
Nigerians Mad Gaan.
I feel sorry for women who still assume that owning a car automatically means a man is wealthy.