If you like, unfollow me after this. I no really care.
Some of you are sacrificing your future in the name of responsibility.
Yes, taking care of your parents is a good thing. Paying your younger siblings' school fees is also commendable. But not at the expense of your own foundation.
Money wey suppose help you start that business, learn that skill, relocate, or build something meaningful for yourself, na the same money dem go call you say, āAunty don swallow shovel,ā or āSchool fees never complete, abeg send something.ā
Sometimes nobody even forces you. But from childhood, dem don condition you to feel wicked anytime you choose yourself.
Meanwhile, na the same money wey fit completely change your life you dey use solve problems wey no get ending.
If the responsibility go destroy my own tomorrow, I no go do am. Because if I collapse today, who go save me?
Even billionaires still dey hustle. Why Femi Otedola never sit down make him children take care of am? Everybody still has their own life to build.
Helping people is good. But don't set yourself on fire just to keep everyone else warm.
If una really know where some of us dey come from, the kind load wey we dey carry for head, the responsibilities wey dey our neck and how hard e be to reach this level, una no go just open mouth talk some kind things.
Everything no be for social media. Everything no be couch, TV stand and fine room pictures.
Some of us dey sponsor ourselves, support family, pay school fees, take care of parents, settle bills and still dey try build a better life little by little.
The fact say my room never look the way you want am make e look no mean say I no dey make progress.
The things wey matter to me fit no be the things wey matter to you.
Before you judge person from one picture, remember say you no know the full story.
You no know where the person start from, wetin him don pass through, and the sacrifices wey him don make to get where him dey today.
I no dey compete with anybody. I dey move at my own pace, and I thank God for how far I don come.
One love šš