No wonder u no wan put mount for the stuff me too don repent
Old thing has passed away, behold all thing's has BCom new !!
Praise the Lord hallelujah .
To whom it may concern
To everybody wey I don drag, troll, quote, insult, or give free headache for this app, I sincerely apologize. 🙏🏾😂
I don retire from my online nuisance era. If I ever used you to catch cruise, abeg no vex. Na old me.
As I dey try turn over a new leaf, make una help me pray make this change last, because temptation plenty for this app. 😭
God bless una. Peace and love from a recovering troublemaker. 🤝