around 2023, i just chop one heartbreak, i begin dey reason life was in my 300L then, as a mathematics student life tuff.
one day i just laid in my tiny room of 30k na so my guy
@Giftox2 call me say make i check my whatsapp, i been no wan check because life don tire me i no go lie.
my parents been no like me again because results in school weren't good.
this my guy sabi say i be meme lord then, i create memes and post lots of memes so he called me to create some memes for him for one project @Entanglefi say the thing suppose bring money in about one month's time about $50.
i made the memes sha and after a month i go meet my guy say how far na, him tell me say them never talk anything yet, my head spark, $50 suppose enter about 80k for naira then, me wey no get reach 3k for aza my body just dey pepper me.
omo na so 4 months pass sha them no pay my head wan blow.. fast forward...
e reach march 12 i been don start my second teaching practice (my final year).
na so i see my second guy wey we gather day that one been (
@0xghandi ) that one been put me on GMRX then but as per newbie for space i just dey disturb am, na so them press me 5k for giveaway i happy like mad so this guy sha tell me say i go smile the next day i ask am say why he talk am he say make i no worry, i just talk amen comot face go my house.
next day truly i been dey teach children for JSS2 na so this my first guy call me say make i send my private key say him wan help me claim.
ah me wey my phone been dey 5% and i no get charger, fuck how i wan do my life i begin dey beg for charger everywhere i see one guy wey we gather dey the teaching practice school sha i beg am he talk say i go spoil him charger i look am shake head i go meet one Alhaja sha she borrowed me sha, na so i charge reach 3% because phone been don die by then my lovely infinix smart 6.
i sha send seed phrase give my guy him claim am con tell me make i send aza, i been dey expect like 50-80k sha, na so my guy wire me 600k, me wey na my mama send me 1k wey i use guide that morning, fuck!
my eye first clear body begin dey shake, na once i call am say hope say no be fraud money abeg, i no want issues with police abeg.
this guy just laugh me say make i find another account wey fit collect reach 1m i dey try close mouth e no gree close sha, i been send my second opay this guy wire 200k go there say he go send the rest later say them don dey give am warning for excessive transactions, this time i don dey fear true true, next day i been send my mama account as per i never do tier 3 for my own account then, ne wey never hold 100k before why i wan dey do tier 3?
next day my mama send me transaction of 1.5m for inside school i begin dey scream like goat.
omo, the rest dey for God sha, God really bless my guy for me.
@plumenetwork gave me more than times 10 of that sha but i really bless that day.
What's the lore behind how you made your first 1M?