I just rememberone thing now😭😂
There was a time I go buy food for one buka. I order rice and stew, add two meat and one ponmo join. After I finish chop, I just check my pocket… na that time I realize say the money wey I carry no reach 😭
I no wan disgrace myself, so I stand up dey look serious like person wey get urgent call. I step small go one corner, put phone for ear dey talk “hello sir, I’m around already… yes sir…” 😭😂
After like 2 minutes, I come go meet the woman tell am say “my boss dey send me money now, small network issue.”
She just look me like say she don already understand everything. She say “oga, no worry, go bring the balance later.”
The way I take comot there that day ehn… I swear I no pass that side for like 2 weeks 😭😂
Till today I never pay 😂